Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 22:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 22:12
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu fit find out where God from kom? Or how E take dey get en mighty and strong pawa?


God high pass di heavens; so wetin yu go fit do? E deep pass where dead body der; so wetin yu feel sey yu know?


Make una si how di kloud high rish! Make una look di sky well-well!


Na God get di heavens, but E don give di eart to human being.


Awa God dey for heaven and E dey do wetin E like.


Make yu dey kareful wen yu enter God temple, bikos to kom meet God make E tish yu, betta pass foolish sakrifice and pipol wey dey offa am, nor know sey wetin dem dey do, nor good.


Make yu tink well-well before yu tok or before yu make promise give God. God dey heaven and yu dey dis eart, so make yu nor dey tok too mush.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ