6 Wen I tink about wetin dey happen to mi, my body go dey shake, bikos of fear.
my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.
I dey shake bikos I dey fear Yu and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz.
I just dey fear dey shake anyhow and I nor fit stop to shake.
Wen ever I tink of God, na kry I always dey kry make E kom help mi.
Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life.
Dem go wear sak as klot for body and dem go dey fall as dem dey waka. Dem go skrape dia head and na shame go follow dem.
I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.