3 Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
Yu feel sey yu words nor go make mi tok? As yu dey tok to God as yu like, so nobody fit tell yu sey wetin yu dey do nor good?
Make yu shut up yor mout, so dat I go tok. Wetin go bi, go bi.
If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?
Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.
My friends dey tok against mi and I dey kry give God.
Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.
“Make yu listin to wetin I dey tok. Dis na all di konfort wey I ask from yu.
But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”