Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.
Weda wi dey raitious or wiked; good or bad; dey klean or not; dey offa sakrifice or not, na di same tin go happen to all of us, bikos pesin wey good nor betta pass sina and pipol wey dey make promise give God, nor betta pass doz wey nor dey make.
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Before-before, dem dey play music with harp to give yu respet, but naw, yu dey with dead pipol. Yu liedan for worm bed kon use di worms take do kover klot.’ ”