Yu know sey, David yor papa and en men strong well-well for fight, like bear for bush wey dey find en pikin. Yor papa na soja wey get sense and e nor dey stay with en men for nite.
Di woman ansa, “I promise with God wey dey alive sey, I nor get bread. Di only tin wey I get na small flower for plate and olive oil for cup. I kom gada firewood make I use take make am for mi and my pikin. Na dat one bi di last food wey wi go chop before honga go kill us.”
God dey give some pipol many propaty, honor and evritin wey dem wont, but E nor dey give dem di shance to enjoy dem. Dem go die, den anoda pesin go help dem enjoy dia propaty! Dis one dey yuzles and bad well-well.