“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
“Israel pipol, dis word wey una dey always tok for dis land, na wetin e mean? Una dey sey, “ ‘Mama and papa dey chop grape wey don sawa, but na di shidren dey feel di sawa taste for dia mout.’ ”
‘Mi wey bi God, I nor dey kwik vex and I dey show my love and goodness well-well. I dey forgive pipol sins and sturbones, but I go still ponish dia shidren-shidren go rish dia third and fourt generashon, bikos of di sin wey dia papa and mama kommit.’
But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.