13 Dem dey live dia life for peace and dey die without trobol.
Dem dey dance, dey play sheke-sheke, harp and dey enjoy dia trumpet sound.
“Some pipol nor sick at-all until di day wen dem die; dem die with happiness and dem dey for peace.
Even before dia time end, wota don karry dem go.
As snow dey dry for heat and melt for sun, na so sinnas go vanish from dis land.
Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.
If to sey I die dat time, I for dey rest naw;
If dem hear God word kon serve am, dia life go get peace and dem go prosper.
E bi like sey dem dey enjoy life and dia body dey fresh and strong.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
Na 10,000 special sojas wey dem choose from Israel tribe kon attack Gibeah. Di fight strong well-well sotey Benjamin sojas nor know sey dem go soon distroy dem finish.