8 Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again.
So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
Fear dey wait dem for evriwhere and e go follow dem as dem dey waka.
Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.
Just as wota dey karry tins go, na so too fear go karry dem go and for nite, breeze go blow dem trowey.
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
Una dey si mi naw with una eyes, but una nor go si mi again. Wen una dey look for mi, I go don go.
E sidan on-top angel feada kon fly go; E fly go with strong breeze.
So my God, wen Yu raiz-up, Yu go laf dia yeye plan; wey bi like dream wey dey vanish wen day break.
Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.
Yu dey swip pipol trowey like dream wey dey vanish. Dem bi like grass wey grow for morning.
Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.
Di king go-go back to en land wey dem protet well, but e go stagga fall and dem nor go si am again.