5 wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last.
Joab ansa, “I nor go waste time with yu again.” So e take three spear kon shuk Absalom for chest, even as e dey struggol for di tree wey e hang put.
Den ten of Joab sojas kon follow am kill Absalom.
So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
Yu go soon tell mi about rish and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.
Doz wey nor know God before dem die, na wish kind hope dem get?
God dey do like dis, so dat wiked pipol nor go rule and opress di pipol.
I don si sey fool fit dey progress, but na wons wahala go kom distroy evritin wey e get.
Yes, dat na all di joy wey wiked pipol get and from inside di eart, odas go kom take dia place.
Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem, una nor go si dem again.
My God, na wen Yu won take judge wiked pipol? Na how long wiked pipol go dey celebrate?
How long dem go dey tok anyhow? Na how long dis wiked pipol go dey make mout?
“Nor bi evribody wey dey koll God, ‘Oga God, Oga God’, go enter God Kingdom, but na only di pipol wey dey do wetin my Papa for heaven wont.
Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.
But as e bi so, yu dey boast dey karry body up. All dat kind boastin nor good.