4 Yu know sey wen God first kreate human being,
God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”
Wi learn and get awa sense from old pipol; pipol wey dem born before yor papa.
Pipol wey get sense don tish mi trut wey dem learn from dia papa;
I tell mysef sey make una tok, bikos una wey don old fit get wisdom wey una go share.
Na God get di heavens, but E don give di eart to human being.