2 “Job! Yu dey make mi vex. Naw, I nor fit wait before I ansa.
Anybody fit argue with mi for dis matter? But if Yu sey I dey wrong, I go kwayet till I die.
Zofar still sey:
All di tins wey yu dey tok since, na curse! But I know wetin to tell yu.
“Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok, bikos I nor fit kwayet again.
As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!”
I kry to Yu as I dey fear kon sey, “Dem don take mi from Yu!” But Yu hear my kry for mesi kon ansa my prayer for help.
Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
Yu don si pesin wey dey tok anyhow? Even fools get hope pass am.
Always dey kontrol yor tempa, bikos vexnashon go turn yu to fool.
But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.
Kwik-kwik e rush go meet di king kon tell am wetin e wont, “I wont John di Baptist head for plate naw.”
I know sey dem love God, but dem nor undastand am,
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.