Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”
But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
God ask Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for dis eart; e dey klean and good well-well. E dey do wetin God wont and e nor dey do bad tins. Yu beg mi make I let yu attack am wen e nor do anytin, but e still dey fear mi as before.”
As dem dey fight, di Israel woman pikin kon curse God name, so dem take dem go meet Moses. (En mama name na Shelomit wey bi Dibri pikin from Dan tribe.)
Thru-out di seven days wey dem do di party, di woman dey always kry for Samson. But for di sevent day, Samson kon tell am di ansa, bikos e dey always disturb am. Den di woman go tell di pipol.