Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 2:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 God ask Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for dis eart; e dey klean and good well-well. E dey do wetin God wont and e nor dey do bad tins. Yu beg mi make I let yu attack am wen e nor do anytin, but e still dey fear mi as before.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 2:3
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na Noah story. Noah na pesin wey dey fear God; e nor get fault for body among evry oda human being. E dey waka with di Oga God.


Joab ansa, “No o-o! I nor go fit distroy una town!


E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.


Just take evritin wey e get from am and e go curse Yu for yor face!”


Naw, wen di day rish for God angels to gada before God, Satan follow dem kom too.


God kon tell Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for di eart; e dey klean and e good well-well. E dey fear mi well-well and e nor dey do bad tins.”


Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!


God kon ask am, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”


Satan ansa, “Di true bi sey, pesin go give Yu evritin wey e get, so dat e nor go die.


E send breeze kom attack and wound mi, even doh I nor do any bad tin.


I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi. Even doh I dey innocent, my mout go still fit put mi for wahala.


My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.


So, make yu follow doz wey dey honest and dey do good, bikos doz wey like peace go get betta future.


Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever.


Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol; but trobol dey always follow wiked pipol.


Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol.


Doz wey dey do wetin dey good, dey fear God; but doz wey dey do wiked tins, nor dey fear am at-all.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.


Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.


Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.


Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.


Afta una don sofa small, God wey koll una with en grace enter en glory for Christ, go make una komplete, una leg go strong and una go get pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ