9 E don take all my glory kon distroy my respet.
E dey make leaders bihave like fools kon take wisdom from rulers hand.
E dey honbol priests and ova-trow doz wey dey pawa.
I dey mourn with sak klot and I use san take kover my face.
“But pipol wey yong pass mi dey laf mi naw! Pipol wey dia papa nor dey yuzful, wey I nor go even allow join di dogs wey dey guide my sheep.
Yu don forget di kovenant wey Yu make with am kon trow en crown for dust.
Yu don break di wall wey dey guide am kon distroy evritin wey dey protet am.
Yu don end en glory kon trowey and skata en throne.
bikos money and propaty nor dey-dey forever. Even nashon nor dey last forever.
Dem go know una as God priests wey bi en savant. Una go enjoy di nashon propaty. Den una go dey proud sey na una own.
Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa.
Efraim greatness go fly komot like bird and dem nor go born shidren. Dia wimen nor go get belle at-all.