6 den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so.
E good as Yu dey opress mi? Yu dey opress wetin Yu make with yor hand. Yu dey happy for wetin wiked pipol dey do?
Why yu dey porshu mi, just as God dey porshu mi? Abi yu neva trobol mi rish?
“As long as God Almighty wey nor gri judge my kase kon make my life bitter dey alive,
Wetin God give lite to doz wey nor get tumoro, pipol wey God surround with wahala?
Yu dey do mi anyhow; Yu dey ponish mi with all yor pawa.
Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
Yu don try well-well, stop to tink bad tins Nor kondemn mi again, bikos I dey rite.
Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu?
Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?
Den I go trow my net on-top am kon katch am with my trap. I go take am go Babilon wey bi Kaldea pipol land (but e nor go si am) and na der e go for die.
Wen many kountries gada, na der I go for katch yu with my net kon drag yu kom dry land.
But as dem dey waka up-and-down, I go trow net wey go katch dem like bird. I go ponish dem for di evil tins wey dem don do.
“But wen una si sey sojas don surround Jerusalem, make una know sey di time wey dem go distroy Jerusalem, don near.