29 But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”
Dem nor get hope to kom out from darkness, bikos swod dey wait to kill dem trowey.
Zofar still sey:
God dey ponish yu, bikos yu too obey and respet am?
Bikos of dis, wiked pipol nor go fit stand for Judgement Day and sinnas nor go fit dey for where God pipol gada put.
But God go reign forever and E go dey judge from en throne.
Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.
For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.