Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 19:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 19:26
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.


No wonder happiness full my heart, bikos I dey rest well and fear nor dey my life.


Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.


God go bless una wey get pure heart, na una go si God.


Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.


Awa body wey don die and rotin go kon shange to body wey nor go ever die or rotin.


E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ