24 Or make e karve and rite di words for stone, so dat dem go dey forever.
“I for like sey somebody go remember all wetin I dey tok, make e for rite dem for book!
But I know sey God dey for heaven and E go kom save mi for di end.
Yu go rite Israel twelf shidren names put for di stones and nor-tin go fit klean dem komot.
Naw di stones dem na God word and na God rite wetin dey inside di two stones.
God sey, “Judah pipol, na iron biro dem take rite una sin; na diamond pin dem take karve am for una heart and di altar korna.
Una must rite all dis kommand for di stone and una go rite am as evribody go fit take si am.”