But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road.
true-true una nor go won wait until dem big rish to marry una! Una nor go fit stay thru-out dat time without husband. Yes! Una nor go fit wait. So my dotas, make una nor follow mi go, bikos my wahala and sofa too many for una to karry and na God dey ponish mi!”