20 My bones just whole my skin and I just manage dey run with my life.
Yu don seize and turn mi to yor enemy. Na skin and bone I bi and pipol dey use am against mi.
My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.
Worm don full my body, sickness don kover my body with dirty; my body don skata with sore.
Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.
Bikos of di pains wey I dey feel, my bones don almost kom out from my skin.
I bi like owl for desert; like small owl for inside-inside wildaness.
and bikos Yu dey vex, my body nor dey strong again, bikos of my sin.
E don make my skin and flesh old kon break di bones for my body.
But naw, dia face don black pass black powder and wen dem dey waka for street, pipol nor even know dem again. Dia body don tin finish and dem dry like dry wood.
Awa skin hot like oven and na honga make us dey sick so.
‘Even di san for una town wey dey awa leg, wi shake am komot make e bi witness against una. But make una know sey: God Kingdom don kom meet una.’