19 My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi.
My family don go leave mi. My friends don forget mi.
Shidren sef dey laf wen dem si mi. Wen I won tok, dem go turn waka leave mi.
To misef, una bi like dat wota; una si fear kon bigin shake.
Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
So Oga God, make Yu sorry for mi. Make I well again, so dat I go pay dem back!
Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.
Dem dey attack dia friends and break di promise wey dem make with dem.
Yu don porshu my friends kon fool mi for dia front and naw, I dey for trap wey I nor go fit run komot.
So Jesus ask am, “Judas, na kiss yu take sell Man Pikin?”