12 En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.
Just like wen strong king dey wait to attack en enemies, na so too fear and pain dey make dem shake,
God don karry mi give wiked pipol. E don put mi for evil men hand.
E dey shot mi with en arrow from difren direcshon. E nor sorry for mi wen E dey wound mi and na my blood wet di groun.
Dem gada kon fight mi; dem drive mi from one place to anoda and dem don agri for wetin dem go do mi.
God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”