9 Trap go katch dia leg kon hold dem for der.
den at wons, Sabean pipol just kom attack and karry all of dem go. Dem kill all di savant and na only mi one eskape kom tell yu.”
As dis one still dey tok, anoda savant run kom sey, “Oga! Kaldea pipol form three group kom attack us. Dem karry all di kamel kon kill yor savant dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
Dem hide rope for dem for groun kon set trap for where dem go waka pass.
Wiked pipol go waka enter net and e go katch dia leg.
Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant; grass go grow kover wetin dem plant. Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty.
Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.
Dem don know God naw, bikos E dey judge well and naw, wiked pipol dey fall enter dia own trap.
Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free.