Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 18:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Wiked pipol go waka enter net and e go katch dia leg.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 18:8
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So my oga, if yu wont, make yu kommand make dem kill all dis pipol. If yu do like dat, den I go get like 10,000 big sak for silva for di royal pus for di kingdom.”


Haman kon tell en wife Zeresh and all en friends evritin wey happen to am. En friends with en wife Zeresh kon tell am, “Yu don dey luz pawa to dis Mordekai. E bi Jew pesin and yu nor go fit win am. True-true e go win yu.”


So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.


Den King Zazes ask Kween Estha, “Na who won kill una? Where di pesin dey?”


Trap go katch dia leg kon hold dem for der.


den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so.


Naw, si as trobol surround yu and fear don dey kill yu small-small.


Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant; grass go grow kover wetin dem plant. Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty.


So make wahala kom meet dem at wons! Make di trap wey dem set for mi, katch dem! Make dem fall enter di pit wey dem dig for mi.


Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.


Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


So make evribody listin to mi! Wahala, big pit and trap wey dem set dey wait to katch and kill all di pipol for dis eart.


Anybody wey run from di wahala go fall for di pit and anybody wey won eskape from di pit, di trap go katch am, bikos wahala like heavy rain go fall from heaven and di eart foundashon go shake.


Wen many kountries gada, na der I go for katch yu with my net kon drag yu kom dry land.


Pipol wey nor dey di church must dey tok good about di pesin wey bi leader, so dat dem nor go disgrace and make am fall enter devil trap.


Pipol wey won get money by force, dey fall enter temptashon and dem dey get troat for yeye tins wey go distroy and put dem for wahala.


Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ