7 Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.
Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”
Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.
Di tin kon make Siria king dey vex well-well. So e koll all doz wey dey advise am kon sey, “E bi like sey one of us dey help Israel king.”
E nor get any nid for mi to kondemn yu; bikos only yor words don kondemn yu.
Wen dia propaty don dey plenty, trobol go kom skata and distroy am.
God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol.
Yu don make betta road for mi, so dat I nor go draw fall.
God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do.
Pesin wey dey good dey always do good tins, but if yu dey do wiked tins, na yor own sin go distroy yu.
Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free.
Nor-tin go stand for yor way if yu dey live wise life, den yu nor go fall wen yu dey run.
Dem go give di juju as gift to Assyria king. Dem go disgrace and make Israel pipol shame, bikos dem go follow juju.
Dis world wisdom, na foolishness for God present. Bikos God word sey, “God dey ponish pipol wey tink sey dem wise.”