6 Di lite for dia house go dark; di lantan wey dey dia room go off.
Dem dey waka find road for darkness. E make dem stagga like man wey don drink well-well.
Dia money nor go tey for dia hand and nor-tin wey dem get, go last. Even dia propaty go finish.
Dem don skata di house where dem for dey save and naw, na di king wey dey make pesin fear, go judge dem.
“Dem don ever kwensh di lite wey wiked pipol get? Wiked pipol don ever face trobol? God don ever vex ponish wiked pipol?
Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
Yu lite one lamp for mi. Na di Oga my God put lite for my darkness.
Na pride dey kontrol wiked pipol and anytin wey kom out from dem, na sin e bi.
bikos wiked pesin nor get betta future and dem nor dey hope for anytin again.
But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.
Wen I don distroy yu, I go kover di sky kon komot di stars. Di sun go hide for di kloud back and di moon nor go shine again.
Even lantan lite nor go ever shine inside yu again! Dem nor go ever hear sey man and woman dey marry inside yu again. Na yor tradas get pawa pass for dis world, bikos yu take yor majik deceive all di oda kountries!