Even doh di mountins and hills go skata, di love wey I get for una, nor go ever end. I go keep my peace and promise forever.” Na God wey love una, tok all dis tins.
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
Anytime di spirit seize am, e go trow am down and e go dey bring foam from en mout, dey grind en tit and en body go kon strait. I tell yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.”
Evil spirit dey worry am and e dey make am shaut. Di spirit dey shake am and foam dey komot for en mout. Di spirit nor gri leave am and e dey trobol am well-well.