3 Wetin make yu dey feel sey wi nor get sense like animals?
“But if all of dem kom follow mi stand, I nor go even si one wey wise.
Yu don klose dia mind, dem nor go fit undastand anytin, but make Yu nor let dem win mi.
“Job, wen yu go stop to dey tok? If yu stop, wi go tok to yu.
Yu just dey kill yorsef with vexnashon. Make di eart skata, bikos yu dey vex? Abi make mountins shake komot where e dey?
I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.
I still sey, “God dey do all dis tins bikos of us, so dat wi go know sey wi nor betta pass animals.”
Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef.
But make una nor flog pesin pass forty times, bikos if una flog am pass forty times, den una don disgrace am bi dat.