20 From east go west, evribody wey hear wetin happen to dem, go fear kon sey,
Dis temple go skata and anybody wey waka pass, go sopraiz. Dem go sey, ‘Wetin make God do dis land and dis temple like dis?’
But God go distroy wiked pipol with en pawa; wen God take akshon, wiked pipol nor get hope again.
My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”
But God just dey laf, bikos E know sey di day to judge dem, don near well-well.
Naw, di land go turn to where pipol go dey fear and hate. All di pipol wey go pass am, go sopraiz and shake dia head, bikos of wetin dem si.
Make una kill all dia sojas anyhow! Babilon pipol own don finish, bikos di time don rish wen I must ponish dem.
Una wey bi wiked and bad leaders for Israel! Di day wey God go ponish una, dey kom.”
den e sey, “I wish sey una know wetin go give una peace today! But naw, God don hide am from una.
Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda, bikos di time wen God kom visit una, una nor know.”