Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 18:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Fire go burn wiked pipol house. Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 18:15
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den God send sulfur and fire like rain kom Sodom and Gomorrah


Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all and na fire go burn di house wey dem build with wayo money.


E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


“E go bad for di king wey build big house with lie-lie and wayo. Di king wey make di men dey work for nor-tin and nor gri pay dem dia salari.


Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah, go happen to Edom pipol; God go distroy dem and di village wey dey round dem. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.”


Oga God sey, “Doz wey dey tif and lie, I go send dis curse go meet dem for dia house and di curse go stay and distroy dem finish.”


but di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fall like rain from heaven kon kill all of dem.


God go turn una rain wey dey fall for una land to powder and san-san; e go fall on-top una until una die finish.


Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ