14 Dem don skata di house where dem for dey save and naw, na di king wey dey make pesin fear, go judge dem.
But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
Di lite for dia house go dark; di lantan wey dey dia room go off.
As dem pul di arrow komot dia body, blood go rush kom out and fear go kill dem trowey.
Dem dey fear morning lite, but dem nor get anytin to fear for nite.
Wiked pipol dey build house like spider own or like where hunta dey stay.
Even di animal wey dey karry body up, e dey look dem like nor-tin; bikos naim bi king among all animals.”
Dem bilive bad-bad tins and dia sekurity bi like spider house.
But E go disgrace pipol wey hate yu and wiked pipol house go vanish.”
Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.
My heart dey beat for my chest and bikos of deat, I kon dey fear.
Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.
Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
and e go free pipol wey deat don whole.