9 But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday.
But Abraham tell mi sey na en sista and even di woman still sey Abraham na en broda. All wetin I do na with betta mind and I neva do any bad tin.”
Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.
God go save pesin wey nor dey innocent, bikos yor hand dey klean.”
I nor go ever agri with wetin una dey tok! I go stand for my rite till I die.
I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.
If I don komot from di rite way; if my heart don follow wetin my eye si or if sin full my hand,
‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin.
So, naw wey di foundashon don skata, wetin good pipol go fit do?”
Na only doz wey get klean hand and pure heart; pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins.
My God, I dey live my life well, so dat I go fit kom yor altar
So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!
Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.
Yu dey provide for dem as dem dey travel go di temple and each of dem dey kom meet Yu for Zion.
My Oga! Di God wey get pawa! Make Yu hear my prayers! Jakob God, make Yu listin to mi!
Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.
Raitious pipol go always dey save, but wiked pipol nor go stay long for dis world.
Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.
Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.
Dem kon si sey Jesus disciples dey chop bread wen dem neva wosh dia hand.
Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.
and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.
Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.