5 Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am.
But, bikos of David yor papa, I nor go do am wen yu still dey life, but e go happen wen yor pikin go dey rule.
But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush.
Pesin wey dey praiz en neighbour anyhow, dey set trap for dem.
Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.
Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.
Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.
For dat kountry, una nor go get peace or rest. And God go make una heart dey fear; una eye nor go dey si well and una soul go dey worry.
As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money.