2 Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.
Yu feel sey yu words nor go make mi tok? As yu dey tok to God as yu like, so nobody fit tell yu sey wetin yu dey do nor good?
Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers.
If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?
My friends dey tok against mi and I dey kry give God.
Naw, God don make pipol dey laf mi; dem dey kom spit for my face.
Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”
Dem go prosper and dia shidren go inherit di land.
Pipol wey dey stay where di Most High God dey, go dey save under en shadow.