15 any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope?
Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
Just as wota dey wosh stone klean and heavy rain dey wosh di san, na so too Yu take distroy awa hope for life.
E skata mi for evry side, until I nor get hope again.
Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.
Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?
My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope.
E sey, “I feel sey as I don live only half of my life, I go die and I nor go si di rest of my years again.
Den I kry kon sey, “I nor get respet again! I don lost evritin wey I hope to get from God!”
God kon tell mi, “Man pikin, Israel pipol bi like dis bones. Dem sey dem don dry finish, dem nor get hope or bilive sey dia future dey brite.