Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 17:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 My plans don fail; my days go soon end and I nor get hope again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 17:11
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw.


But my friends don turn nite to day; dem sey lite don near, but na darkness I dey si.


My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope.


Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.


Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.


E sey, “I feel sey as I don live only half of my life, I go die and I nor go si di rest of my years again.


Even if una plan, una nor go susid. Make una tok anytin wey una wont, but all of dem go dey yuzles, bikos God dey with us.


So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?


My brodas and sistas, I wont make una know sey I don plan to kom visit una many times, but God nor let mi kom until naw. Bikos I won gain from una faith as I don do with Gentile pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ