5 But fit to sey na mi I for enkourage yu. I go try reduce yor pains.
If na yu dey face wetin I dey face so; true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok. I go shake my head kon tok against yu.
“But e nor get wetin I go tok give yu, wey fit help mi and even if I kwayet, e nor go remove my pains.
I dey lead dem as king dey lead many pipol kon konfort dem wen dem dey face trobol.
“Pesin wey dey face dis kind trobol, e suppose get betta friends; weda e forget God or not.
True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense.
So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.
Just as iron dey make iron sharp, na so too, two pesin dey learn from each oda.
Just as perfume and fine oil dey make pesin happy, na so too betta advise from pesin friend, dey bring joy to en heart.
My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.