Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 16:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 E dey shot mi with en arrow from difren direcshon. E nor sorry for mi wen E dey wound mi and na my blood wet di groun.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 16:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hunta go attack am, dem go shot and oppoz am.


En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.


I go si am with my eye and E nor go bi anoda pesin at-all.


As dem pul di arrow komot dia body, blood go rush kom out and fear go kill dem trowey.


Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish?


Aldo I get mind with dis sey: Even with all di pains wey I get, I neva ever go against God word.


God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.


I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.


E set arrow kon shot us like sey wi bi en enemies. Yes, en rite hand dey ready to shot. E kill us with awa strong men kon pour en vexnashon like fire for Zion head.


E drag mi komot for road; tear mi to pieces kon leave mi and nobody dey to help mi.


and naw, E don shot mi and di arrow enter my heart.


“So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.


True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!


God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.


God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ