10 Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.
Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”
Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to only yu?”
God don karry mi give wiked pipol. E don put mi for evil men hand.
Dem gada kon fight mi; dem drive mi from one place to anoda and dem don agri for wetin dem go do mi.
Dem dey open dia mout against mi like lion wey dey hongry.
My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata. My heart bi like kandol wey dey melt inside mi.
My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!
But wen I fall, dem go dey happy kon gada demsef togeda dey dance. Dem gada togeda to kause wahala for mi and dem nor gri stop or taya.
Dem go dey shaut, “Yes o-o! Yes o-o! Wi don get am at last!”
Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.
Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite kon kondemn and kill innocent pipol.
I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.
All yor enemies dey laf and happy sey, “At last, wi don distroy am! Wi don dey wait for dis day since and naw, e don kom.”
Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.
Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.
Dem kon spit for en face, beat am and some slap am,
Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Priest kon orda di pipol wey stand near Paul sey make dem slap am for mout.
“True-true, Herod, Pontius Pilate, Israel pipol and doz wey nor bi Jew kon gada for di town against Jesus Christ, yor holy savant wey yu choose
Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.