5 Na yor sin dey kontrol yor mout and na yeye words yu choose to tok.
E go show yu sey wisdom get many side. Wisdom nor bi simpol matter. God nor even ponish yu rish as yor sin many rish.
But tif and pipol wey nor dey fear God dey live for peace, even doh na God hand dem dey.
Yu nor dey fear God? Yu nor dey respet am at-all?
No! Na bikos of yor sin and all di oda bad tins wey yu do.
So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut.
Den Elihu wey bi Barakel pikin from Ram family for Buz kon dey vex. E dey vex, bikos Job sey e nor do God anytin.
E skata and make sure sey wayo pipol nor fit do wetin dem plan!
E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work.
Dem don sharp dia tongue like swod kon ready to shot dia betta words wey bi like arrows.
Dia mout sharp like arrow and na so-so lie full am. Dem dey tok well with dia neighbours, but for dia mind, na trap dem dey set for di pesin.
Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.
If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.