Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 15:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Yu nor dey fear God? Yu nor dey respet am at-all?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 15:4
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

No wise pesin go tok as yu dey tok so or sey en dey rite with en yeye words?


Na yor sin dey kontrol yor mout and na yeye words yu choose to tok.


God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?


“But if na mi, I go look for God kon komplain gi-am.


“Pesin wey dey face dis kind trobol, e suppose get betta friends; weda e forget God or not.


E don rish time wey God go take akshon, bikos dis wiked pipol dey break en laws.


Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.


Wen dia rilashons; di pipol wey go burn di dead body go kom karry di body komot from di house, dem go ask di pesin wey dey di house sey, ‘E get any oda pesin wey dey here with yu?’ Di pesin go ansa, ‘No!’ Den di rilashons go sey, ‘Kwayet! Make yu nor just menshon God name.’ ”


I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”


Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.


So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.


I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ