31 If dem nor get sense rish and dem kon dey bilive bad tins, na di bad tins go follow dem.
Na God get strent and wisdom; di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, all of dem dey God hand.
I neva do wiked tin before and I neva ever lie to anybody.
E nor get nid for dem to kry; bikos God nor dey si or hear dia kry.
But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.
So, make yu nor trust wetin yu get thru opreshon! Nor put hope for wetin yu tif! If yor money many, make yu nor too happy.
Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.
bikos wiked pesin nor get betta future and dem nor dey hope for anytin again.
E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”
Una dey go kourt and dey lie for each oda head. Una dey put hope for lie, so dat una go win una kase. Una dey make plans to take hurt oda pipol.
So mi wey bi God dey warn una naw sey, make una nor deceive unasef sey Babilon sojas nor go kom back kon attack una, bikos dem go really kom back.
Wen una plant breeze, una go harvest heavy rain. Una korn nor go produce bread. Even if e produce, na strenjas go chop am.
Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.
Bikos if anybody tink sey, en too big wen e nor bi anytin, e dey deceive ensef.
Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am.