24 Just like wen strong king dey wait to attack en enemies, na so too fear and pain dey make dem shake,
Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart. Na pains go full dia years for dis world.
Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
Dem dey waka anyhow dey find food. Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
bikos dem dey tok to God anyhow, dey make mout for di Oga wey dey mighty.
God dey vex for mi, so E kount mi join en enemies.
En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.
Even doh pressure and wahala dey make mi taya, yor kommand still dey make mi happy.
Dat time, trobol go kom meet una like heavy breeze and una pain go sirious well-well.
but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.
But as e dey sleep, evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.
I don give orda to di sojas wey I choose, I go take revensh thru di sojas wey I give pawa to fight and dem go show as I dey vex rish.
God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’
Anybody wey dey do bad tin, weda e bi Jew or Gentile, must sofa and receive ponishment.