22 Dem nor get hope to kom out from darkness, bikos swod dey wait to kill dem trowey.
E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”
Dem dey waka anyhow dey find food. Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
Dem nor go fit run from darkness; dem go bi like tree wey en branches don burn finish and dem go skata as God breath.
But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”
If dia shidren many, dem go die for war and di ones wey remain nor go si food chop beleful.
E nor go let dem distroy demsef; E go save dem from deat.
But if dem nor gri listin to God word, dem go die and dem nor know anytin before dem go where dead body dey.
Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?
Even if I koll am and E ansa mi, I nor go bilive sey E dey listin to wetin I dey tok.
So Judas kon trow di silva koins inside di temple, den e komot go hang ensef.