20 Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart. Na pains go full dia years for dis world.
Si! Yu dey porshu mi from di land and I must hide make Yu nor si mi. I go dey waka without house for dis eart; so anybody wey si mi, go kill mi.”
doz wey God give di land before any strenja kon stay with dem.
Just like wen strong king dey wait to attack en enemies, na so too fear and pain dey make dem shake,
“Why God nor set di time wen E go take judge pipol; di day wey E go judge di pipol wey dey woship am?
Zofar ansa, “Na so God take dey ponish pipol wey dey like trobol and do wiked tins.
So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry.