2 “Pesin wey get sense dey tok anyhow? Abi di east wind fit make am beleful?
Wetin yu know, I know am too. Mi and yu na di same.
Den Elifaz wey kom from Teman kon tell Job:
No wise pesin go tok as yu dey tok so or sey en dey rite with en yeye words?
My own word wey bi true nor dey good, but na di yuzles words yu like.
“Job, wen yu go stop to dey tok like dis, wen e bi sey di word wey dey yor mout bi like strong wind?
Wise pesin dey tink well before e dey tok; so wetin e tok dey give pipol hope.
Just as pesin kom out from en mama belle naked, na so too e go-go back naked and e nor go karry anytin follow body.
Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.
Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.
Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.