16 how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
If yu go gri listin, I go esplain give yu. I go ansa yu from wetin I know.
Bikos bad tins sweet, dem kon keep some for dia mout
Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow?
yu tink sey E go bilive who E make from san; sometin wey bi dust wey fit skata like ant house?
So I dey shame, bikos of all wetin I don tok and I go pak dust for my head to take show sey I dey sorry for all wetin I tok.”
But nor bi so. Evribody don dey sin; evribody don spoil finish. E nor get anybody wey dey do good at-all!
If witness for kourt dey tok wetin e nor si, den di judge nor go fit judge well. Wiked pipol like to dey do evil tins.
Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.