12 Wetin make yu nor dey rizin well again? Wetin make yor eyes dey weak,
But for yu Job! Make yor heart dey rite before yu koll God.
sotey yu dey tok all dis kind words, bikos yu dey vex for God?
Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.
Pipol wey nor know God go just dey vex and even wen E ponish dem, dem nor go sey make E sorry for dem.
Make Yu nor let my enemies happy sey dem win mi. Make Yu nor let pipol wey hate mi, even doh I nor do anytin, happy bikos I dey sofa.
Dem go use dia eyes take make sign kon use dia legs and fingers take deceive pipol.
Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.
So make yu turn from sin kom meet God and from di bad tins wey dey yor mind and pray make God forgive yu.