8 Even if di rut don old and dia part dem don dey die,
“Tree wey dem don kut for groun get hope, bikos e fit still grow again and e nor go die.
wen wota tosh am, e go grow like seed wey dem just plant.
God pipol wey don die, go kom back to life! Dia body go raiz-up again. So, all of una wey dey grave, make una wake-up kon shaut with happiness, bikos una go grow well like grass wey dew fall put and di eart go bring back evritin wey don die.”
I tell una true word, if one korn seed fall for groun and e nor die, e nor go grow, but if e die, e go grow kon bear plenty seed.
Una bi fool! Wetin pesin plant nor dey grow, unless di seed first die.