3 Yu dey open eye look dis kind pesin? Yu go gri judge mi so?
Na ordinary leaf wey breeze dey blow Yu won fight? Abi na dry leaf Yu won porshu?
Yu don put big shain for my leg and evriwhere wey I waka go, Yu dey wosh mi.
God dey ponish yu, bikos yu too obey and respet am?
If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.
Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.
My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?
I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?”
Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.